The mata wey shele for Eva Adelaja Girls Secondary School for Bariga, Lagos don collect work from the hand of the principal Mrs C. O. Coker, Vice-Principal, Mrs Balogun plus 4 other teachers O. Tori dey yarn us say the teachers wey get hand for the mata na Mr Bello (Mathematics), Mrs Tejumaye (English language), Mrs Omoge (Physic Education) and Mr Bakare (Economics).
Tori say dem collect work from dem afta dem shine light on the mata as per how dem beat one girl, Ogechi Anyalewechi, on March 16. Dem say the Permanent Secretary for Lagos State Ministry of Education, Mrs Olabisi Ariyo say dem commot dem bcos of the flogging mata and dem no go work for the school again from Thursday, March 24. Dem flog Ogechi for y**sh afta dem say she slap dem headgirl for the school. Dem say na headgirl first slap am before she return am and the head girl go report. No be only flogging O, we hear say she still cut grass for like 4 hours. Tori yarn us say na Lagos State University Teaching Hospital dem carry Ogechi go. Na that time, Commissioner for Youth and Social Development, Princess Uzamat Akinbile-Yussuf say make the Directorate of School Social Services for her ministry go shine light on top the mata.
No comments:
Post a Comment