Monday, March 7, 2016

SEE YEYE O... INI EDO FANS SAY NA WEDDING GOWN SHE WEAR FOR AMVCA

MISS SIMPLICITY - Chai dem don finish d AMVCA 2016 since Saturday but Ini Edo fans just start their own ooooo.come see hw dem dey yeye d actress lik sey tomoro no dey...Sum tok sey she fall their hand sake of sey she wear wedding gown go Eko hotel dat day...Sum sey she for kuku bring husband nd pastor come d hotel. Sum even tok sey e be like sey na her wedding day but she miss d venue... Lailai...lala una wan finish her???  For me o, d dress make sense die, na just d color spoil ham... Abeg make una free d actress oooooooo b4 una go kill me wit laff.

No comments: