Chaiii...Mrs. Ocholi wey dem rush go one local hospital for Doka, Kaduna State,let from where accident for happen yesterday. Dem don confirm say she don kpain O, some few minutes after dem carry her enter. Tori yarn us say as Mrs. Ocholi kpain so, na him make the number of pipu wey kpain 3. Dem say Oga minister, James Ocholi bin dey travel go Kaduna with him wife and first son. And all of dem kpain, when him driver slam brakes of dem Lexus SUV car when he dey on top speed. Na security car wey dey dem back, Halla the driver say make he dey careful O cos one of him Taya wan burst, na so the guy fear go March brake. As e March am, na so security car wey still dey run come from back go jam dem, wey make dem somersault plenty times and na immediately Oga Ocholi and him first pikin.
No comments:
Post a Comment