Some pipu na winsh O... Another badt guy don still scatter Jamb record. Tori yarn us say one guy from Kogi state don get mark wey high pass for the history of JAMB UTME for Naija. The efiko wey him name na Ibrahim Shakkiru score 399 out of 400 leave 1 for Jamb make e no be like say he too dey greedy. Na Nigerian University Scholarships share the result with the full world online say dem don see winsh O. The result say the guy wan study Medicine and Surgery for the Ahmadu Bello University, Zaria, Kaduna State. E be like say dem don born some winsh now O... cos na just last month UNILAG sef get students, Daniel Dada Ayodele wey scatter dem own record with 5.0 CGPA for the first time since dem start the school. Dem sama the guy 1 million naira for him convocation and plenty company don talk say dem wan give am job, even MTN join dem.
No comments:
Post a Comment