Shebi na last week tori dey circulate say one of we senators, Dino Melaye take Edo State Governor, Adams Oshiomole rob am when he dey yarn about make pipu dey buy things wey dem do for Naija. Dino bin talk say Oga Adams and pipu like ma wey dey go marry outside Naija no dey help us, say make dem born again. But na today we hear say Oshiomole don carry vexnation reply say make we no blame Melaye O, na person wey get family go fit sabi talk about family. He say the full world sabi say Melaye no get beta family and him no still dey buy Naija, cos all those big big cars wey he dey show for social media no be made in Naija. He say make Naija pipu just bone Melaye cos him na just a rude boy wey like to talk too much.
No comments:
Post a Comment