Saturday, March 26, 2016

SEE WHY BUHARI SAY HE HIM SELF SABI SAY HE NO DEY TRY



President Muhammadu Buhari on Thursday evening don yarn say even himself Sabi say he no try at all for the elections wey shele Kogi, Rivers plus Bayelsa State. He say e be like say plenty pipu kpain demself for Rivers pass as dem do for many other State. 


At dis level wey we dey now, e no make brain make we still dey fight for our elections but say make we no vex cos he go do something before next general election. Tori yarn us say na so Baba yarn when he dey talk to dem APC pipu for dem NEC meeting for Abuja. Presido come beg dem military plus security pipu,  say make dem no let bad pipu use dem don ojoro for elections again. 

No comments: