Saturday, March 26, 2016

MIKE BAMILOYE SAMA US MOUNT ZION'S OLD PINSHURE OF LIFE





Wow.... See old pinshure of life wey Baba Mount Zion, Pastor Mike Bamiloye share for him Facebook page. From wetin Ishawuru write, he say the pinshure na from July 11, 1986 for St Margaret Girls Grammar School, Ilesha and dat na the first time wey Mount Zion Faith Ministries go show for stage and title of the drama wey dem do Dat year na, HELL IN CONFERENCE. 


Man of God say na one full year dem take ready for the play and na that dream God take launch dem ministry on stage. But Sha dem no even get video of how the mata be dat day, but dem snap pinshure. The pinshure funny no be small cos Baba himself na him do Mr. Nigeria and wetin surprise me pass na say him babe, Momsy Gloria Bamiloye follow am dey Dat year and na she dey inside the foto as person wey Baba no even remember the name...... Lol.

No comments: