Thursday, March 3, 2016

SEE WASH O... SENATOR DINO MELAYE TAKE OSHIOMOLE WASH AM FOR INSIDE SENATE

Senator Dino MELAYE wey dey represent Kogi West don Edo State Governor, Adams Oshiomole wash am for inside we Senate,  wen dem dey yarn on Wednesday. He do the funny thing wen dem dey talk about pipu buy things wey dem do for Naija wey Senator Abaribe from Abia South sponsor. Senator Dino Melaye say dem gats reason many things before dem start to dey talk of made-in-Nigeria. He say Naija pipu dey like prefer imported babe's to made-in-Naija babes”,  and everybody just Sabi say na Oshiomole he take dey rob am. He finish him yarns when he dey ask him goons inside Senate make dem become ‘Born again’ make dem dey marry made-in-Nigeria babes.

No comments: