Arsenal Fans make una calm down first, na summer job no be full time job O. After plenty years wey he don dey coach Arsenal, Arsene Wenger don get a new job for him country, France. Tori from britiko yarn us on Wednesday say Baba Wenger don get job to be coach for Euro 2016 wey go start for time wey no too tey. The Daily Star UK reports say na him Padi wey be PSG presido, Nasser Al-Khelaifi get am the job. Dem say dem believe say the guy go follow dem philosophy, no go do like some coach for dis side of the world wey dem and dem Oga go dey drag over every mata.... Me sha no mention person name O! Wenger go dey work with former French international Marcel Desailly plus the before Arsenal attacking midfield wey Sabi wella, Robert Pires.
No comments:
Post a Comment