Thursday, March 24, 2016

SEE BEG O... READ HOW PIPU WEY KIDNAP STUDENTS FOR LAGOS DON DEY BEG




LWKMD... The school Principal for Babington Junior Seminary, Ikorodu, the school where dem for kidnap 3 school girls, Venerable Olaoluwa Adeyemi yesterday yarn teacher plus parents say one of the badt guys wey dem don catch say na dem kidnap the 3 students don dey beg the school say make dem pray for am. 

He say the badt guy don take plenty messages scatter him phone dey beg say make dem forgive am. He still talk say dem don carry the fence for the school go up and dem don get patrol van wey go make dem security improve. Adeyemi say dem don still get CCTV plus security lights round the school to sama dem beta security. One of the Papa wey dem carry him pikin,  yarn for himself and others say dem hail the school well sake of say dem help dem get dem pikin back come still sama dem beta security.

No comments: