MISS SIMPLICITY - The beautiful actress wey bin para for "This day magazine" on top d best dressed actors nd actresses wey dem pick for a AMVCA don still com out com clear pipu wey bin dey think sey Yoruba actors nd actresses no sabi speak English. For one interview, she tok sey anytime wey pipu tell her sey dem no knw sey she sabi speak English, she go just laff bcos she no sey na bcos those pipu no knw anytin. Now she don call
on all d other Yoruba actors nd actresses sey time don reach o to make pipu know sey dem too dey part of Nollywood bcos separation no suppose dey at all. She tok sey even tho pipu don dey recognize dem now, sum still dey see dem like pipu wey no go skul bt dat one no bother her as e be sey with time o, pipu go understand wella. Mercy Aigbe tok sey she see all Nollywood actors nd actress as one on sake of sey na naija movies dem dey do. Finally, finally she com still tok sey she o, dey inside one Hausa film wey go soon come out. Hmmmm, true tok ma'am, me I see Yoruba actors nd actress as pipu wey dey carry our culture come out, I appreciate dem nd I knw sey many pipu out there appreciate their work too...
No comments:
Post a Comment