MISS SIMPLICITY - My two leg don carry me waka enta India again nd many tori dey hot dia nd one of dem na d tori of Bipasha Basu nd Karan Singh. The two lovebird meet for where dem for dey shoot one movie wey e name be "Alone" nd d two actor nd actress begin dey do tins nd go places togeda. Even tho dem bin no dey wan tok abt their relationship before Karan Singh mama accept Bipasha, tori tok ham sey
dem two love demselves like sey tomorrow no dey. D very hot actress Bipasha nd d cute Karan Singh don com out now com tok sey their wedding go sele on d 30th of April dis yr nd many Bollywood actors nd actresses don dey send their goodwill message give Bipasha nd Karan on top sey d actress na one actress wey don suffer many heartbreaks before nd dem dey hapi sey dis their relationship o go soon get hapi ending wit God's help.. Wow!! Me sef dey hapi, I dey wait for d celebration, I knw sey e go make sense bcos d two pipu wey wan marry so na Bollywood actor nd actress wey dey gbono feli feli nd I dey say "Aapko Shaadi Ke Badhahiya Pehle Se Mubarak Ho" to one of d hottest Bollywood actress wey dey act, move nd dance wit style nd swag...
No comments:
Post a Comment