Friday, March 25, 2016

OUCH... LIKE DON JAZZY, SEE HOW 9ICE TOO DON YAB LINDA IKEJI




For time wey no too tey na him Oga Don Jazzy take Linda Ikeji rob am as per say she never marry. Anoda person don still hammer am and dis time na Broda Adunni, 9ice for him new single, At The Moment (ATM). If you first hear the song e be like say na hailing, However, but na later you go see say na yab he dey yab her. 


For inside the song he say he dey find plenty money,  say he dey feel like Linda Ikeji, many money wey dey come from Dasuki.” Tori yarn us say no be first time wey 9ice go yab her be dis. In 2013, 9ice do same same when he say Linda dey put him song for free on top her blog. Na so Linda too Dat time say 9ice go pay before she fit put him song for her blog. 9ice come vex para say he go tear for anybody wey put him song on the internet for free. Na some months ago, we hear say Linda Ikeji collect from Dasukigate money,  say na N240m, Sambo Dansuki Roger her,  but she don talk say na lie sha.

No comments: