MISS SIMPLICITY - Adesua Etomi wey be British, Nigeria actress wey bin win d "Best Female Actress" for d 2016 AMVCA naim we don hear sey she dey for d new drama wey Michello Bello dey direct now, wey dem call d name "And the Spirit Slowly Dies" D story na abt one pikin (Adesua Etomi) nd her rich papa wey dey gist wella base on sey dem bin love demselve u nd dem bin dey hapi bt tins com dey dey change small small as d papa nd pikin no com dey gree again sotey dem no wan dey see each oda again...
Michello Bello wey bin direct "Flower Girl" dat African Comedy wey bin win award for 2014 don tok sey she dey hapi sey she dey work wit Etomi on top sey she get talent, she know wetin she dey do nd she dey put mind, head nd body for anytin wey she dey do... Na Dapo Oshiyemi, Dipo Abdul nd Mmabath Kau go produce ham then Talking Drum Entertainment go distribute nd na dem be consultant too. Hmmmm dis news dey totori my body on top sey na naija tins, I knw sey d drama go make sense bcos Naija no dey carry last....
No comments:
Post a Comment