Wednesday, March 23, 2016

ON TOP WETIN?... 18 YEARS OLD GIRL CARRY HOT WATER BAFF ONE GUY



One 18-year-old girl, Godiya Atunbi na him dem don catch carry go court by the police for Kebbi State say she don take hot water baff one boy in top say dem get gbege. The boy wey dem call him name Umar Bashir dey emergency ward for the Argungu General Hospital. 


The boy Papa say na small thing cause wahala between dem O, he say the girl, Godiya don first vex carry broken bottle wan take chuke Umar but dem hold am,  na so everybody come think say the mata don finish be dat. Dem no know say na so she enter go carry hot water take baff the boy.

No comments: