MISS SIMPLICITY - Nigeria carnival go sele for Maryland on Sunday July 24, 2016 nd d carnival na to showcase how our culture, language nd lifestyle make sense reach nd base on sey na d first time wey dis carnival go sele for Maryland, d tin go get seminars, workshop nd street carnival wey go show d different states wey dey Naija o.
D Ondo state actor Yemi Olatunji, wey we know as Yemi Blaq naim be d cultural ambassador wey dem pick nd he don tok sey dis yr carnival o, go make sense die base on sey na Naija culture dem go showcase. He com still tok sey una go see hw dem go take dey drink palm wine from calabash, drink our pepper soup nd plenty plenty ogbonge soups wey dey for Naija. Make I try quote wetin him tok "We will interface wit African American community in Maryland. We are partnering with the state government culture nd tourism boards.." Confirmento our culture too make sense...we no dey carry last anywhere bcos anywhere wey we enta, we dey represent. Oga Yemi Blaq, u too much nd we for TPN dey say congratulobia ooooo....
No comments:
Post a Comment