Wednesday, March 23, 2016

OMAWUMI DON READY TO START HER FOUNDATION

E be like say everything don ready for Omawumi to start her foundation wey she call, ‘Little House of No Regret.’ The foundation go be for women and girls, to take stop gbege wey dey shele for house and take care of make pipu wey dey suffer dis kain thing. When she dey yarn about the level on social media, Omawumi say e don tey wey she wan stop domestic violence plus help pipu wey dey suffer am. Omawumi say the name, Little House of No Regrets na the name wey her grandpa; Maxwell Allwell-Brown give him shop for Aba tey tey before dem born am. She say dem still get plenty things to learn and dem go soon yarn us more tori on top the mata.


E be like say everything don ready for Omawumi to start her foundation wey she call, ‘Little House of No Regret.’ The foundation go be for women and girls, to take stop gbege wey dey shele for house and take care of make pipu wey dey suffer dis kain thing. When she dey yarn about the level on social media, Omawumi say e don tey wey she wan stop domestic violence plus help pipu wey dey suffer am. 

Omawumi say the name, Little House of No Regrets na the name wey her grandpa; Maxwell Allwell-Brown give him shop for Aba tey tey before dem born am. She say dem still get plenty things to learn and dem go soon yarn us more tori on top the mata.

No comments: