Tuesday, February 23, 2016

ADONBILIVIT... WAEC SAY MAKE NGO PAY ALMOST 2 MILLION NAIRA TAKE GET BEST STUDENTS NAME.

Dis one be like film trick when I first see am on line,  say one NGO,  Edubox, weyi one MR. Sanusi Tosin dey represent send letter give WAEC, say dem wan dey give award to students wey pass well for waec,  so make dem give dem record of student wey pls well for all states wey dey Naija. The man say he shock O,  wen he get reply from Waec say he go pay like 1,850,000.00, almost 2M make dem take process wetin he dey ask for, he say he try yarn dem say no be money he wan take am make na. Na just to encourage students but Waec no gree O. Abeg I no understand, shey dem wan arrange anoda exam ni abi give am record wey dem don already get. Na all dis kain yeye thing dey Taya me for dis we country. Sai Baba shey you dey hear sha O!

No comments: