Saturday, March 12, 2016

NAWA O... SEE HOW DONALD TRUMP YAB MUSLIMS AGAIN FOR HIM NEW CNN INTERVIEW



Republican, Donald Trump don yab Muslims again for one recent interview wey he do with  CNN. He say he think say Islam hates dem, he say Islam too hate dem, na so he yarn Anderson Cooper of CNN, when dem ask a weather the religion dey fight war with the West. He say dem no go fit allow pipu wey hate dem country dey come into the United States. Make we no forget say he don first burst kamala when he say dem no go allow muslims enter the U.S again if dem elect am president.

Meanwhile, Hillary Clinton and Bernie Sanders don yab am too for wetin he yarn about pipu wey come work for US and dem minorities. Hillary say na she first tey coach the guy when he dey call Mexicans rapists, wey she no like. She say America pipu no go vote for presido wey dey insults Mexicans, insults Muslims, insults women plus insults African Americans. Abeg na who dis Oga Trump never yab sef? I taya O!

No comments: