Saturday, March 26, 2016

GHEN GHEN SEE WETIN STELLA DAMASUS WAN SAMA HER FANS





MISS SIMPLICITY - STELLA DAMASUS DON DEY PLAN TO SAMA US WIT HER GOSPEL ALBUM wey she call "The alternative" tho she bin don drop singles like "The man nd "Ja Gi Mma" wey her husband Daniel Adenimokan help her produce bt now she don upgrade.
As we knw sey Genevieve Nnaji na d first to release album wey she call "One Logologo Line" for 2004, Omotola Jalade sef drop us wit her own wey she call "Me, Myself and Eyes" for 2010, Stella don decide sey na she go be d third nollywood actress wey go release full album too. Hmmmm I dey see tins, nd make I no lie una, d tins dey sweet my body base on sey Stella Damasus na one actress wey fit make any body heart make jigi jigi anytime, any day.

No comments: