Tuesday, March 1, 2016

COURT SAY MAKE ABBA MORO PLUS 2 OF HIM GOONS GO DEY TAKE BREEZE FOR KUJE

Federal High Court Abuja don talk  say we former Interior Minister, Abba Moro plus 2 of him goons make dem dey go take breeze for Kuje prison till March 2nd, when dem go come talk about how dem go bail am. Dem show dem 3 face before Justice A.I Chikere say dem do 11 bad things. EFCC dey follow dem enter the same trouser on top the Nigerian Immigration recruitment gbege wey happen in 2014 where like 20 pipu wey dey find work for kpain.  Na him make dem catch Moro plus Mrs. Anaesthesia Nwaobia, wey be Permanent Secretary for the ministry plus one Deputy Director for Finance, F.O Alayegbami, who dem talk say na him do the pull out. But sha o, all of dem say na lie o, dem no dey guilty.

No comments: