One Naija Army Major plus 3 soldiers na him dem don shoot die for Abonnema wey dey Akuku-Toru local government area for Rivers state. Dis one na as e no pass 48 hours again wey dem go do election re-run for the state. One tatafo na him yarn Saharareporters say the soldiers go fall for one trap wey some badt guys set take way lay dem for the state.
The state Governor , Nyesom Wike still busy dey do rally and dey threaten anybody wey dey reason am say he wan do Ojoro for him party wey be PDP, say na kpain dem go kpain.... Na so Saharareporters take write am.... Dis Saharareporters sha.... dem sabi cause quarrel. But if you get person for that side abeg halla am, make he or she relocate for some time O, COS when soldiers dey vex, person wey no sabi anything fit chop wetin he no cook O.
No comments:
Post a Comment