Sunday, March 6, 2016

AWWW... CLARION CHUKURA DON MARRY HUSBAND NUMBA 3 AT AGE 51

Ghen ghen...Nollywood actress who still be Mama of beta music video director, Clarion Chukwurah don marry again to her boyfriend.  The 51 year old Mama wey dey happy anyhow come climb on top Facebook come polongo to the full world as she come even show her guy face. Mama say ‘History made, destiny fulfilled, me and hubby on Savannahs Street, Georgia. ' But Sha she no gree tell us the name of her guy. Wetin tori yarn us be say Mama born her first pikin, Clarence Peter for Afro-Juju originator, Sir Shina Peters when she small (e be like say SSP just chance her Dat year), but she still Waka commot from her first marriage to one Mr. Abiola in 2003. She marry got again for February 14, 2004 to Femi Oduneye, one popular jingo wey everybody Sabi as Femi Egyptian. Dem come still separate on May 5, 2006 and dem bin come back together again 6 years ago before dem come still scatter everything recently. We say Happy Married Life to Mama Clarence,  I dey suspect say she fit be Toyin Aimakhu mentor O... Abi you no think so?

No comments: