Saturday, March 5, 2016

ALLELUYAH : INDIAN ACTRESS PRETTY ZINTA DON MARRY AFTA 41YRS

MISS SIMPLICITY -  Na so I sey make I waka enta Bollywood, d tori wey dey hot dia be sey d pretty "Kal Ho Naa Ho" actress don marry her boyfriend Gene Goodenough hmmmm u go fear name. D tin happen for Los Angeles nd all d Bollywood actors nd actress dey hapi for her nd dem don dey send her confam congratulations msg for her twitter.
D tin wey come dey totori me be sey even tho dem dey over busy, d king of Bollywood ( Shakrukh Khan) nd d very Being Human boss (Salman Khan) dey go for Priety wedding reception wey go sele for Mumbai bcos Priety na one of their best actress nd bcos sey she be gud frds to those two actors...Me I dey sey big Congratulobia to one of my favorite Bollywood actress too infact I say "Salaam Namaste...

No comments: