Taiwo Aromokun na one actress wey make sense wella, nd she dey like do film wit Odunlade Adekola, tori even tok sey dem two na padi. D actress don com back from obodo 'yinbo afta 3yrs wey she don go dia wit her twin boys (Jaden nd Jamie) wey make sense die. D actress bin travel wen e remain small for her to born pikin bt now she don land for our obodo 9ja wit afro hairstyle wey she spray white. She tok sey as she land so, she go start to dey sama us wit beta beta film again like d way she dey do before she travel. No think ham too much bt d actress go paint d movie industry red as she land so...Taiwo Aromokun ur head dey dia.....
No comments:
Post a Comment