Like play, like play.... Oga Chairmo for National Union of Road Transport Workers for Oyo State plus South West dey on top one yoruba programme today for Splash Fm. After plenty interesting questions and answers. Na so dem Presenters, Kola Ladoke plus Folake Otuyelu open phone line. As God dey work, na so the last caller ask Chairmo why dem no build Dat kain hospital where dem go dey carry dem members go incase of accident. As if say Fele dey wait for Dat kain idea before na so he grab am, say he promise, come even call walahitalahi join say dem go build Dat hospital before next time wey he go come on radio. He say dem go build am for Lagos Ibadan Express way and dem go employ doctors wey go dey work for there. Toor..... Alhaji Fele we believe you O. God go help you.
No comments:
Post a Comment