Senate for Naija don dey Para for The Chairmo for Northern State Governors’ Forum, NSGF who still be Governor for Borno State, Kassim Shettima, say make dem no reason am say dem wan go collect loan from Saudi Arabia. Tori yarn us say na 2 weeks ago Shettima carry four northern governors waka go Saudi Arabia go toast the Islamic Development Bank, IDB for loan.
But Sha O, he say dem just go there go see as e dey be ni, no be say dem wan collect loan. But Sha O, Senate don dey clear dem say dem no get power to borrow that kain money under we constitution without say National Assembly yarn dem carry go, so if dem do am dem dey do wetin law no support, so make dem no even reason am at all at all. Dem come tell dem say make dem dey try read O, COS if to say dem dey read ni, dem for know say wetin dem wan do no follow under we Law. Dem come still advise the Islamic Development Bank make dem no give anybody that kain loan O, cos if dem do, na OYO dem dey O, that is to say On Your Own. Vanguard say wen dem Halla Senior Special Assistant, Media and Publicity to we Presido, Mr Garba Shehu, he say Presido no get anything to yarn on top the Mata.

No comments:
Post a Comment