Monday, February 15, 2016

SEE GBEGE O, POLICE CATCH MADMAN WITH PLENTY ATM CARDS FOR LASGIDI

Nawa O!  Wetin we no go hear for dis Naija, we don see plenty fake things, now we don catch anoda fake craze man for Lagos. And wetin dem see for him hand no be laff mata O,  for him hand dem see 22 ATM cards, 1Nokia phone, 1 blackberry, 1 power bank plus plenty bank tellers of money wey dem just pay enter bank and invoices. The crazeman wey dem call him name Lanrewaju Jaiyeola, 39 years old na him police catch follow him kuru kere movement and how he take carry him bag for Ozumba Mbadiwe Road. 


Tori yarn us say 8 out of the 22 credit cards na him still dey work and dem be from different banks. When he dey confirm the Mata, dem Rapid Response Squad Oga, ACP Olakunle Disu, say when the guy show for dem office, things wey he yarn na him make dem sure say the guy craze no get NAFDAC number,  na fake. He say the guy don first dey talk well O,  before he just wake-up himself start to dey form craze again,  dey threaten Police officer wey dey in charge of him mata, saying he go make life taya am if he no free am. Nawa again O! 

No comments: