No be small clearing O, The Prelate for Methodist Church Nigeria, Dr. Samuel Uche, don advise President Muhammadu Buhari say make him start him anti- corruption fight from the 2nd Republic wey Baba Shehu Shagari bin dey ontop in 1979. he day na the only way be Dat O, wey presido fit take fight corruption true true.
He say make he still shine the anti corruption light enter the domain of him Padi dem wey dey him government O, cos na Dat time we go Sabi say him truly mean business. Na Saturday he yarn all these things when he dey answer questions from reporters for the first Founder’s Day anniversary plus inauguration of Very Rev. Sunday Onadipe as Rector of
Methodist Theological Institute, Sagamu wey dey Ogun State.

No comments:
Post a Comment