Wednesday, February 24, 2016

POLICE CATCH MAN WEY DEY THIEF FOOD FROM IDP CAMP FOR MAIDUGURI

Some Pipu no dey fear God O,  you no fit help pipu wey dey suffer,  come still dey add your own bukata join dem palava. Na so NEMA put am for dem Facebook page say dem Task Force don catch one gonfabi wey dem call him mumu name,  Sulaiman Abba. Dem catch am where he for dey move food wey belong to pipu wey war don chase commot from dem dommot. Na so dem catch am, say na him gangan be the Devil. Nawa for some yeye pipu O!

No comments: