Na wa wa O, police don catch 3 pipu, say dem kpain one 40- year-old woman wey her name na Helen Peters. Dem name na, Uwadiegwu Henry, 25, Monday Ochonu 25 and Taiwo Adebiyi, 57 who do the bad thing for 36, Fashola Street, Papa Ashafa, Agege. Na when dem catch dem, 25 year old Henry start to dey confess say him na lover boy for the 40 year old madam, na money he wan collect from the woman husband wey get money wella, na him make am plan with Taiwo wey be Nurse. Dem come give the woman craze pipu injection wey dem dey call Lagatine, so dem go fit carry her run, na the third guy help dem tie the woman. Na so the woman sha mistakenly go die for dem hand sha, COS cloth wey dem take cover her mouth no allow her breath.The Magistrate, Mrs K. A. Ariyo push g e mata go March 31.

No comments:
Post a Comment