EFCC don carry letter go Federal High Court for Lagos, say make court give dem power to go seize some properties of Government Ekpemupolo, alias Tompolo, before the guy show for court come answer the N45.9bn
wayo case. Na EFCC lawyer write the letter where dem write list of properties wey dem go like siddon on top. Some of dem na his house wey dey No. 1, Chief Agbamu Close DNA Extension Warri (Effurun), Delta State, others na Minka Dive Ltd.; Mieka Dive Training Institute Ltd.; Global West
Vessel Specialist Ltd.; Muhaabix Global Services Ltd.; one
River Crew Change Boat wey him name na MUHA -15; "Tompolo
Dockyard," "Tompolo Yard," the Diving School for Kurutie,
Escravos River plus "Tompolo House" wey dey Oporaza Town, opposite the Palace. Dem even beg the court make he allow dem siddon on top things wey fit move like cars etc. Dem day no be today dem don dey call Tompolo wey he no gree show face and as dem don find am reach dem no see him brake light. So if dem seize him property dem believe say he go come out from where he dey hide.
Friday, February 19, 2016
EFCC WAN SIDDON ON TOP TOMPOLO PROPERTY BCOS DEM NO SEE AM CATCH
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment