Abeg who no where Bros dey O, You say which Bros? Na Government Ekpemupolo na, wey everybody sabi as TOMPOLO. Date wey dem say make dem carry am come court go soon reach on the 19th of February and dem never smell him shadow, nobody sabi where he dey, talk less of say dem go catch am.
The koko of the whole kasala come be say him brotherly for Ijaw no ready to yarn anybody where dem chairman dey. Tori yarn us say the pipu of Gbaramatu-Ijaw wey dey Warri South-West Local Government Area for Delta State, no dey take am play O. One King wey yarn, talk say no correct Gbaramatu pikin go tell anybody where Tompolo dey, he say anybody wey do that kain thing no get pure Ijaw blood for him body. He say only Tompolo na school O, for the full Niger Delta cos the Bros don do beta for plenty pipu and dem dey see am as persin wey don struggle make am, wey him story come dey ginger other pipu, so make federal government no reason am say dem wan follow am drag mata O, make dem just settle the whole mata ni, make peace for reign na wetin me I dey call levels be that.

No comments:
Post a Comment