Yesterday many Arsenal fans dey on top mountain dey pray make God do miracle for dem against Barcelona, but e be like say God na Barca fan yesterday. Barca go dem Emirate Stadium go teach Gunners how dem dey play football. Although Arsenal too try O, but dem no fit score wen dem get chance and na so Barcelona take score first goal wen Arsenal don dey think say God don answer dem prayer. As if say dat one no reach, na so dem bring dem player Mathieu Flammini enter, make he come defend and he come go fall Messi wey make referee blow penalty and Messi wey no be mumu score am again. So Arsenal go need magical miracle now to take qualify for this stage.

No comments:
Post a Comment