No be small mata O, Rumour just dey fly anyhow say Cynthia Morgan don get Belle for her Oga, Jude Okoye wey be Senior broda of dem Psquare, we no even Sabi maybe Psquare still dey abi dem don scatter the group cos the gbege wey dey shele for inside dem family house no be here. Buy sha O, one fan of Cynthia Morgan, wey him name on Twitter na Expensive_is_sh#t na him ask her on Twitter if na true and she quickly say na lie O, say Jude na her Oga O and na business dem dey do together, dem no dey chop yam. Na so? Make we Seddon dey observe like National Observer.
No comments:
Post a Comment