Thursday, February 18, 2016

PETER P SQUARE DON VEX OPENING DEM FAMILY YANSH ON TWITTER

Me no wan take side for dis mata but e be like say, dem don force Peter of Psquare do somethings wey be taboo for Africa as the guy don vex climb Twitter go explain some of the things wey dey cos gbege between am and him senior brother Jude. Wetin dey vex am pass na him twin brother, Paul wey go polongo say him start with dem broda. Peter send plenty tweet on how he go meet him brother to yarn and the brother say make he dey talk where him Padis dem dey,  how him brother thief Cynthia Morgan from him hand and how he say him no dey resign as dem manager unless Dan scatter Psquare. Some pipu think Peter own too much but me go say make we sodden dey look nonii,  na only God fit make Psquare survive dis gbege.

No comments: