So this Bros dey fear like dis? Wetin dem don do am wey he dey resign? Tori wey enter we hand dis early mom of today Friday, 26th February be say Oga COACHIE for we Super Eagles, Sunday OLISEH wey don dey get gbege with him NFF Oga don finally climb Twitter go yarn the full world say he no do again, he don resign. He say na salary wey dem no pay, and how dem no dey corporate make am resign, he don forget to add how dem take dey carry juju test him body. But sha O, NFF never yarn on top the level.

No comments:
Post a Comment