Friday, February 26, 2016

E BE LIKE SAY FUNKE AKINDELE DON DEY DO OLAJUMOKE FILM O

I trust my Naija pipu,  we ni dey carry last,  na anything wey dey sell we dey carry body put. We don see select babes,  Azonto babes ,  blackberry babes like dat like dat. E be like say dem don dey shoot Agege Bread babe O. Dis one na as we see one pinshure online yesterday, where FUNKE AKINDELE wey everybody Sabi as Jemima wey she balance bread for head like Olajumoke for one street. Na him show us say e be like say dem don dey take Olajumoke story do film be dat. Cos the Olajumoke too don talk say she go like act yoruba film sef.   Naija I hail una,  abeg if na true say na Olajumoke story,  wetin go fit be the title... Modeli Agege Bread?.... Lol!

No comments: