Thursday, February 25, 2016

INA LILAHI, WAHINA ILAEHI ROJIHUNA... BABA LOJA FOR ALESHINLOYE MARKET, IBADAN DON KPEF

TOMINSIN

As e dey hot.....tori wey dey enter we hand now dey conform am say D Baba Loja for the popular Aleshinloye market for Ibadan, Alh. Lasisi Aremu don kick bucket dis evening...And as d news dey reach our hand, dem go bury the Baba tomorrow morning as dem dey arrange am for Muslim pipu...make una follow us do the waka tomorrow as we go waka reach there go see hw baba go take enter ground for him house wey dey Apata market Ibadan. We for TPN pray make God sama am beta sleep.

No comments: