SARS for Lasgidi don catch one Kunle Oshineye, aka Eyin Bouncing say kpain 2 pipu for Akoka, Bariga. The Oshineye guy wey dem go catch for one owanbe on Friday na chiefo for NURTW for Jibowu Area. Tori yarn us say the guy na tingo, he dey Eiye Confraternity and na dem fall was Daniel plus Aiye wey be Aiye members on January 22, 2016. Dem even kpain one 63- year-old businesswoman, Mrs. Adejoke Adefuye for Oshinfolarin Street, Bariga, wen the gbege dey shele. Police say the guy don confess, say na dem fall those guys and him dey Eye cos if person no dey cult, e no fit join NURTW for Jibowu Area, but wen the guy yarn with press pipu, he say na lie O. He just talk like Dat so police no go take beating finish the litu wey remain for him destiny.
No comments:
Post a Comment