Friday, February 26, 2016

GLOBACOM DON COMMOT FROM PSQUARE BACK, SAY DEM BE RUDE BOY

BERNARD - Na true say anythin wey get beginning go surely get end...One of d networks wey dey make sense for Naija, GLOBALCOM don commot for the back of psquare as e be like say dem don fumble.  Tori yarn us say the brodas wey no dey follow each other play again plus dem big bros, Jude OKOYE start to dey get gbege with glo for the final of DANCE WITH PETER cos Peter yab some glo Oga,  and na even the gbege no make dem perform for GLO CAF AWARD. Glo say even if na true say dem still dey owe dem some Kain money but dat one no say make pikin begin slap hin mama... Na hin dem yarn say enough is enough... Make dem Waka far.

No comments: