Nawa O, Annie wey be 2Baba official wife wey still dey do film don carry vexation climb on top instagram go put pinshure of one babe like dat say abeg make una help me warn her make she free my family O. Tori yarn us say na immediately she put am, she commot am sha, but some baddest pipu don munch am. Aproko pipu don go shine light for the matter see say the babe name na Ayabime Okpo and she bin dey run package with 2 Baba before, now e come be like say dem don re-connect, coded tiny and now Annie don hear say there is another fire on the mountain, dem even say the babe na family of Oga Raymond Downes, wey get Daar Communications and dem get cash for dem house. Abeg if una Sabi Bime as dem dey call the babe, tell am make she free Baba O. But come O, say 2Baba no just dey.............
Tuesday, February 23, 2016
ANNIE IDIBIA SAY MAKE UNA HELP AM WARN DIS BABE WEY WAN SCATTER HER FAMILY O
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment