As e be say, we Naira no get shame again, wey he just dey fall, dey open him ya*sh anyhow, especially for parallel market. The chairmo for Capital Oil and Gas Services Ltd., Dr. Ifeanyi Ubah, din talk say if federal government go fit ask am for help he go help us catch Naira, bring am back to N200 per dollar under one month. Na for Channels TV, Ifeanyi Ubah dey advise we Federal Government say make dem go collect advice from some Naija pikin, say person like am fit to save Naira if dem give am chance, but he no gree yarn how he wan take do am, he say na him business and him business na him secret. Wetin come make me believe am na, when he talk say government fit seize everything Wey he get if he no deliver in one month after federal government give am carry go. Presido abeg make we give am go ahead abeg!
No comments:
Post a Comment