Tuesday, February 23, 2016

CONGRATULOBIA... K1 DE ULTIMATE DON BECOME AMBASSADOR FOR GEELY MOTORS FOR NAIJA

Congratulobia to the Caboni Tutti for Fuji Music, King Wasiu Ayinde Marshall wey everybody Sabi as K1 DE Ultimate cos na yesternite I see am for him official Facebook page wen dem polongo say Alhaji don become the brand ambassador for GEELY motors for Naija. And on to,  who he be,  we Sabi say plenty millions go don swim enter Alhaji bank account. He come still yarn us wey be him fans make we dey expect him next music project,  wey he call 'LET THE MUSIC FLOW' e be like say him feature Hip Hop Artistes wella for the album,  one of dem wey sure me doe na Patoranking. No shaking we dey wait. And we for TPN say congratulobia Alhaji.

No comments: