Tuesday, November 24, 2015

RADIO GIRL RONKE GIWA CARRY NO TOUCH ME THERE MESSAGE GO SCHOOLS

Na everyday we dey hear of differnet kain yeye things wey dey shele to small pikin all over Naija. You go hear some, he go be you like say na lie. That na why radio girl, Ronke Giwa plus including some of her padis dem carry the mata for dem head go schools for Ibadan, make dem dey go teach school children wetin dem call good touch and bad touch. Dem call the campaign No Touch Me There..#DontTouchMeThere So small children go fit sabi when elderly persin don dey pass him boundary. According to wetin Ronke write on top her Facebook page, she say dem read from inside one book by Pastor Nomthi, to yarn the children, the difference wey dey between good touch and bad touch. And the school wey dem go na Juniors International School and she don yarn am say dem go still carry the message go many other schools. I just pray make dem no sideline children wey dey public schools, cos e be like say na dem dey hear am pass. Una do well o, Ronnie G and her padis dem.

No comments: