Mark 8:27-35
That time Jesus move with hin followers go village of caesarea Philippi for road hin ask hin disciples 'wetin d people talk say I be?' then con answer am, some say John d Baptist, while other people say Elijah, some still yarn say you be prophet,he con still ask, una wey dey yarn, who una think say I be? Peter answer am 'you be Christ now' jesus con say 'make una no tell anybody about me o. He con begin dey tell dem say man pickin must suffer, elders, chiefs, priest, and even d scribes go bone am, dem go even kill am but after three days man pickin go show ba-ground again.Jesus just yarn normal but Peter con dey yarn say 'God forbid' jesus look Peter tell am say 'commot for my front dey my back u witch because no be God side u dey na man side u dey support. He con call hin followers say 'if anybody wan follow me,make hin ready well well carry hin cross oya make we move. For who keep hin life go loose am, but who loose hin life because of me go see am collect back. FROM THE PIDGIN BIBLE.
Monday, October 5, 2015
WE BIBLE TORI FOR DIS WEEK FROM WE PIDGIN BIBLE-OGINI BERNARD (OB) VERSION
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment