Thursday, October 1, 2015

TO DEY RUSH NA RUBBISH, TO DO THINGS WELL BETA PASS RUSH...DAPO LAM YARN US FOR INDEPENDENCE

As per say independence fever still dey catch Naija, 55 years no be beans. Na him make plenty pipu dey yarn dem mind. We number 1 man for Naija don first hail us early momo today, na so pipu wey dey political office too dey do. Dat na why one of we Honourables wey dey represent us for House of Rep for Abuja, Hon. Dapo Lam yarn us him mind too. He say rushing na nonsense and to do things well beta pass make we rush do am. To come finish am he say make we try change our bad ways, make we dey do right things, dey obey law for everywhere, school ni, hospital ni, garage ni like dat like dat. And make we get patience we'll so we go fit chop the igbadun of democracy wella.

No comments: