Sunday, October 18, 2015

DEM DON SAMA OLUSHINA OLABODE AWARD SAY HE BE COMRADE AMBASSADOR FOR HOPE & PEACE FOR THE MASSES

One of the presenters wey popular pass for Space fm 90.1, wey still be dem Head for yourba entertainment, Olushina Olabode wey everybody sabi as Omo'ya Shina climb on top facebook today, Sunday 18th October, 2015 dey hail Baba God of Joseph Ayo Babalola plus Prophet E.O. Adepoju say God don do am better as ROCAHAM ASSEMBLY wey be group of Human Right Activists don sama am award wey dem call Ambassador for Hope and Peace for the Masses. Na so the bros, carry the award give Baba God, him station Space Fm 90.1, him friends, fans plus family. So we for TPN say Congratulobia bros.

No comments: