Make Baba God save us from pipu wey no sabi anything wey wan carry dem mumu-ness scatter we country. Una no go believe say the Fulani pipu wey carry Baba Falae for him farm just dey reason how dem wan get money take flex for sallah, na him one persin say make dem go carry one Baba wey dey come him farm with Hillux Jeep. But sha dem don catch dem from all over Naija come even show dem face for the full Naija pipu. Wetin funny me pass for the mata na say, one of dem carry the 5million Naira run, the money wey dem take bail Baba Falae for dem hand....so kidnapper carry money, thief collect am again. Na so we for start war kill ourself finish, when the mumu wey kidnap no even sabi wetin dem dey do.

No comments:
Post a Comment