Tuesday, October 13, 2015

OYA NA...DAPO LAM DON WIN FOR TRIBUNAL O, THAT IS TO SAY...NO SHAKING

Yesterday na Jubilation tinz for inside the dommot of Dapo Lam Adeshina wey dey represent Ibadan South East/North East Federal Constituency for we House of Rep for Abuja as Tribunal wey dey siddon for Ibadan don tell am make he dey carry go, na him win election true true. Na 3 ogbonge Judges siddon on top the mata and na Justice Taiwo be dem chairmo, na so Dapo carry all glory give Baba God wey no allow enemies fall him hand. He come promise say him pipu no go regrey say dem vote for am cos he go do dem beta. Since yesterday na so so congratulobia messages dey full him page. So we too from TPN say congratulobia.

No comments: